Wetin Really Dey Happen for Umahi House?

Date:

Na one matter wey don set social media and news space on fire be this.

One young medical professional, Mary Habila, die under circumstances wey still dey raise plenty questions. Reports talk say the incident happen for house wey dem link to Minister of Works, Dave Umahi.

Since the news break, different groups don begin demand make government carry out independent investigation so Nigerians go know wetin really happen. Some people even don call on the minister to step aside until investigation finish.

For him own side, Umahi don deny any attempt to cover up the matter. According to am, medical personnel try save Mary, and him support proper investigation to uncover the true cause of her death.

Another twist come later as reports say Mary family file affidavit ask make police release her body for burial and indicate say dem no want autopsy again. That move too don spark fresh debate across the country.

As e stand now, investigation never officially conclude, and no authority don accuse or find anybody guilty over Mary Habila’s death.

For now, Nigerians still dey wait make investigators provide clear answers to the many questions wey this case don raise.

As we dey bring you tori wey concern our yard every Saturday, remember say Tori for Yard na your space too. If anything dey happen for your area wey you wan make the world hear, send am come ENN — together, we go make sure every voice counts.

LEAVE A REPLY

Please enter your comment!
Please enter your name here

Share post:

spot_imgspot_imgspot_imgspot_img

Popular

More like this
Related

Ebonyi High Court Acquits Three PDP Ward Officials of Cultism, Forgery Charges

An Ebonyi State High Court sitting in Iboko, Izzi...

Nwifuru Urges IFAD to Expand Agricultural Value Chain Programme to All 13 LGAs in Ebonyi

Ebonyi State Governor, Francis Nwifuru, has called on the...

2027: Odii Promises ₦2 Trillion Investment for Ebonyi Within Six Months

Ebonyi State Peoples Democratic Party (PDP) governorship candidate, Chief...

Ebonyi Police Forward Alleged Defilement of Three-Year-Old Girl Case to DPP

The Ebonyi State Police Command says it has completed...